Posts

Showing posts from February, 2020

Okada Ban and Im Effect for Lagos People Body

Image
Some days ago na so we hear say government go ban okada and keke for Lagos. We be think say na lie the first time o, later, na so we come see say na true. E don reach make people come dey trek upandan for Lagos like dis. For my area, wey be say na Ogba, people been dey enter bus go Berger for 100 naira but as keke and okada no come dey now, na 500 naira Danfo buses dey carry am. From Ikeja underbridge to Ojuelegba and Yaba wey be say na 200 or 150 before, dem don dey carry am for 250 or 300 naira now. E jus be like say government no want make average people dey stay dis Lagos. If you no get car like dis, na to start suffer head, begin dey waka na im remain. Just imagine say person dey collect 30,000 for salary for wan month, how that kain person wan take survive for this kain time? And nor be say companies go come say because Sanwoolu don ban keke and okada now, dem go come increase your salary. E nor dey ever follow laik dat. People jus dey complain say this government nor just t