Okada Ban and Im Effect for Lagos People Body

Some days ago na so we hear say government go ban okada and keke for Lagos. We be think say na lie the first time o, later, na so we come see say na true. E don reach make people come dey trek upandan for Lagos like dis.

For my area, wey be say na Ogba, people been dey enter bus go Berger for 100 naira but as keke and okada no come dey now, na 500 naira Danfo buses dey carry am. From Ikeja underbridge to Ojuelegba and Yaba wey be say na 200 or 150 before, dem don dey carry am for 250 or 300 naira now. E jus be like say government no want make average people dey stay dis Lagos. If you no get car like dis, na to start suffer head, begin dey waka na im remain.

Just imagine say person dey collect 30,000 for salary for wan month, how that kain person wan take survive for this kain time? And nor be say companies go come say because Sanwoolu don ban keke and okada now, dem go come increase your salary. E nor dey ever follow laik dat. People jus dey complain say this government nor just try at all. No be the promise wey dem promise when dem dey campaign for elections be dis.

Make una see the pictures of Lagosians wey dey waka because bus no dey for down:

Related image
My own consign now be say the government be like say dem nor sabi wetin dem dey do. If person wan try new sumtin for the kain place wey Lagos be, dem suppose try am fess, make dem see say e dey work before dem go come begin ban the alternative wey people don dey use tey tey. Oyibo people go say make you no put the cart before the horse but for this Lagos kasala wey don burst so, no be only cart dem put before the horse, dem join wheelbarrow sef put before the horse.

I hear say dem don ship 65 buses and 22 ferries enter the city but make we remember say e get some kain streets wey small pass where bus fit enter and nor be everybody dey stay where water dey.

I nor sabi how our governor, Sanwoolu wan take do this thing but my own advice be say anything wey im wan do, make e dey try consider the masses. Nor be everybody get car and nor be everybody get money to dey enter Uber or Bolt anytime wey dem wan comot for house.

Make the governor think am well well before e talk say im decision  na final. For this kain time so, na make Lagosians start to dey do everyday exercise before solution go come. Make una kpele my people, e go better one day.

Comments

Popular posts from this blog

Books for You This Lockdown Period

Sheila's Musings

'Tis the Season of Generosity: Heartwarming Christmas Gift Ideas for Every Family Member